
Callum Hudson-Odoi don become di first Premier league player to test positive for coronavirus.
Dis dey come afta Arsenal manager Mikel Arteta dey self-isolate imself afta him too test positive for di virus.
Dem don postpone Arsenal game against Brighton on Saturday but dem neva take decision on Aston Villa game against Chelsea wey suppose happun dis same day too.
- Mikel Arteta don get Coronavirus – See how e happun
- Nigerian footballer don become di first player to get Coronavirus
- La Liga don dey suspended as dey quarantine Real Madrid squad
Di Premier League go do “emergency club meeting” on Friday to discuss future fixtures.
Chelsea say Hudson-Odoi “begin display symptoms wey dey like pesin wey get cold on Monday morning” and im no come for training.
But di club add say di player dey “do well and im dey look forward to returning back to training ground as soon as e dey possible”.
Chelsea full squad dey on isolation.